13 I don si sey, just as lite betta pass darkness, na so too, to know sometin, betta pass foolishness.
Yor word na lantan wey dey guide my leg and lite wey dey make mi si road.
Di tishing for yor word dey give lite, so even pipol wey nor go skool dey undastand am.
Wise pipol know where dem dey go, but foolish pipol dey deceive demsef.
E betta well-well to get wisdom and undastandin, dan to get gold and silva.
Yu go nid to use more pawa take kut wood if di axe wey yu dey use nor sharp, so make yu sharp di axe well. Dis na di value wey dey wisdom and e go help yu susid.
Lite sweet well-well and e dey good to si anoda new day.
Pesin wey wise, strong pass ten pipol wey dey rule di town,
So I kon si sey, wisdom betta pass pawa, but nobody go respet wise man wey poor; nobody go gri listin to en advise bikos e nor get money.
So wisdom dey good pass swod, but one sin fit distroy many-many good tins.
Den my pipol go si di difren between good and bad and between doz wey dey serve mi and doz wey nor dey serve mi.”
But if pesin eye blind, den darkness go full en body. If di lite wey dey inside una na darkness, di darkness big well-well!
Before-before, una dey for darkness, but naw, una bi lite wey dey shine inside Christ. So make una dey do tins like shidren wey get lite,