9 Nor bi sey na only sense di tisha get, but e still dey tish di pipol how to get wisdom. E take en time take tish and show dem many proverbs.
Yor ofisas and savants go dey happy well-well, bikos dem always dey with yu, dey hear di wise tins wey yu dey tok!
E rite 3,000 parabol and di songs wey e rite, pass 1,000.
God keep en promise kon give Solomon wisdom. Peace dey between Hiram and Solomon and dem make agriment with diasef.
Solomon, David pikin wey bi king for Israel, na-im rite all dis wise word.
Dis na di wise words wey Solomon tok: Shidren wey wise dey make dia papa proud, but fools dey kause pain for dia mama.
Dis na some of Solomon oda wise words and na King Hezekaya men for Judah kourt, rite dem down.
But wise pipol go shine like lite for di sky. Doz wey tish pipol di rite tin, go shine like star forever and ever.