4 If yor oga dey vex for yu, make yu nor vex stop di work wey yu dey do, bikos gentol spirit dey korrect big mistake.
Pesin wey dey kwik vex, naim dey first kause fight; but kwayet pesin dey kwayet for evriwhere.
Na patient and gentol tok, pesin dey take beg kings and na sweet mout dey setol sirious wahala.
E get anoda bad tin wey I don si for dis world and na big mistake wey kings dey make,
Make yu nor rush komot from di king present; nor put yor hand for bad tin, bikos di king fit do anytin wey e like.