Yu go still tell dem, ‘My papa give una hard work do, but I go make di work hard pass as e bi before. Na ordinary kane e take flog una, but na koboko I go take dey flog una!’ ”
Wiked men dey opress my pipol and doz wey borrow dem money, don turn to dia oga. My pipol, una leaders dey lead una anyhow and naw, una nor know di rite road wey una suppose follow.
“Make una listin to wetin mi wey bi God dey tok. Make una make sure sey dem dey always give korrect judgement for kourt. Make una protet pesin wey dem dey opress from who dey opress am and bikos of di bad tins wey una dey do, my vexnashon go burn una like fire wey nor dey kwensh.