So I try to search evriwhere to get wisdom and to undastand why tins dey happen di way dem dey happen and I dey ready to prove to mysef sey, wikedness dey stupid and foolishness dey bring madness.
Wen Herod si sey di wise men deceive am, e vex well-well, so e send sojas make dem go kill all di boys wey don rish two years kom down, bikos e don rish two years wen di wise men kom meet am sey, dem si di star.
For di fourt day, dem kon tell Samson wife to bi, “Deceive yor husband to bi, so dat e go tell yu di ansa of wetin e tell us; if not, wi go burn yu and yor papa family togeda, bikos e bi like sey yu invite us kom here, so dat wi go dey poor.”