Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Ekklesiastes 1:9 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

9 Wetin don happen before, go happen again and wetin pipol don do before, dem go do am again, bikos nor-tin dey new for dis world.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Ekklesiastes 1:9
10 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

E get anytin for dis world wey fit make pesin sey, “Kom si o-o! Dis one neva happen before o-o”? But di trut bi sey, e don happen even before dem born us.


So I kon sey, make I try know di difrence between wisdom and foolishness. Abi e get anytin wey who take-ova from mi won do, wey I nor do before.


Wetin dey happen naw, don happen before and wetin go happen for future don still happen before, bikos God dey make di same tin happen again and again.


Evritin wey dey happen, na wetin God don sey go happen and all of us know sey, yu nor go fit argue with pesin wey strong pass yu.


Nor ever ask, “Wetin make evritin bad dis days pass as dem bi before?” Bikos e nor dey wise to ask dat kind kweshon.


But naw, I go do new tin; e go happen and una go si am! I go make road for di wildaness kon give una plenty wota for der.


Pipol wey nor bilive, na wen una go stop to waste una time? Mi wey bi God promise to bring new tin kom dis eart and e go dey special like wen woman dey protet man.”


As fake profets dey among di pipol before, na so fake tishas go dey among una too. Dis fake tishas go tish lie-lie tins wey fit distroy pesin and dem go sey dem nor know di Masta. Like dis, dem go distroy demsef.


Den I si new heaven and new eart. Di first heaven and eart nor dey again and di sea vanish.


And di Pesin wey sidan for di throne kon sey: “Make yu look! I dey make evritin new!” Den E kon tell mi, “Make yu rite all dis tins, bikos dis word na word wey pipol fit trust and na true.”


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ