5 Di sun dey raiz-up and down, den e go hurry go anoda place where e go for raiz again.
“As long as di eart dey, time go dey to plant and time go dey to plok wetin dem plant. Sometaims kold go dey and oda times heat go dey. Rain go fall sometaims and oda times evriwhere go dry, but day and nite go always dey.”
My God, just as deer dey find wota to drink, na so too I dey find Yu.
where arrow go for enter en heart. E bi like bird wey dey enter net and e nor know sey en life dey danger.
“If yu fit break di kovenant wey I make with nite and day, so dat dem nor go kom out again for di korrect time,
As dem si yor arrow dey kom with speed and as yor spear dey shine, di sun and di moon nor fit move komot from where dem dey.