I really tink well-well about wetin wine go fit do for mi. I bilive sey na wisdom I dey use and I nor go bihave like fool, so dat I go know wetin dey good for pipol to do for dis world, as dem dey live dia life wey go soon end.
Den I tink of all di work wey pipol dey do and I kon si sey, evritin wey dem dey do, na to know who betta pass. But all dis tins dey yuzles too, e just bi like wen pesin dey porshu breeze.
E betta make yu get small propaty with peace for mind, dan to dey work hard, bikos yu nor go still gain anytin and e bi like wen pesin dey try to katch breeze.
Dis na di bad part about evritin wey dey happen for dis world: na di same tin go happen to evribody. Plus dis sef, na wikedness full human being mind and na wetin dem like dem dey do, den one day, dem go die.