But I nor bilive until naw wey I don kom si evritin by mysef. I nor even hear half of wetin I don si; bikos yor wisdom and propaty many pass as dem tell mi.
My men go bring di woods from Lebanon kom di river kon tie dem togeda and float dem kom di place wey yu choose. Den, my men go luz dem and yor men go karry dem go. But I go like make yu give my men food.”
Gehazi wey bi Elisha savant kon tink for en mind, “Si, my masta nor gri take wetin Naaman bring kom. As far as God dey alive, I go run go meet am kon kollect some tins for mysef.”
Hiram still sey, “Na di Oga God for Israel deserve all di praiz, bikos na-im make di sky and di eart! E don give David one pikin wey wise and undastand sey e suppose build temple for God, plus royal palis for ensef.
So I tell mysef, “Na wetin go happen to fools, go still happen to mi! Both of us go still die! So wetin I kon gain with all dis wisdom wey I get?” So I kry kon tell mysef, “E nor get any good tin wey wisdom dey give!”
E go bad for di king wey sey, ‘I go build big house for mysef; di room for up go get betta space.’ So e put windows for di house, use cedar wood take dekorate am kon paint am with red kolour.