7 Make una dey do una work with betta mind like sey, na Christ una dey do am for and nor bi human being,
Una know sey I don serve una papa with all my mind and pawa,
Den en savants go tell am, “Awa oga! If to sey di profet sey make yu do one big tin, yu nor go rush go do am? So dis one wey e sey make yu do, nor hard at-all, just go wosh yor body, so dat yu go well.”
But wi tank God sey, even doh una bi slave to sin before, una don use una heart dey obey all di tins wey wi dey tish una.
But anytin wey una dey do, weda una dey chop or drink, make una do am to honor God.
Anytin wey una dey do, make una do am with all una body, like sey una dey do am for Christ and nor bi for pipol,