I know sey Yu dey test evribody heart and Yu dey like doz wey dey respet diasef. I put my body for groun kon use all my heart take give Yu all dis tins and I don si how all yor pipol dey happy as dem dey give Yu dia gifts.
Oga God ask di priests, “Pikin dey honor en papa and savant dey respet en masta, but wetin make una nor dey honor mi wey bi una papa? If I bi una masta, why una nor dey respet mi? Una nor dey respet mi, yet una dey ask, ‘How wi nor take dey respet Yu?’
“Nobody go fit serve two oga, e go hate one kon love di oda one, or e go serve one with all en heart and nor respet di oda one. Nobody go fit serve God and money for di same time.
Misef, I bi man wey get oga and I still get sojas wey dey under mi. If I kommand one sey make e ‘Go’, e go-go, if I kommand anoda one sey make e ‘Kom’, e go kom and if I kommand my savant make e ‘Do dis tin’, e go do am.”
Slave wey God choose make e follow Jesus, don bikom free man thru Jesus Christ. So free man wey God choose make e follow Jesus, don turn to Christ savant.
Wi dey happy, bikos wi know sey di way wi dey live awa life for dis world and how wi dey bihave with una, dey show sey na God send us thru en pawa, nor bi human being own.
So, my friends wey I love; pipol wey dey always obey mi, (nor bi only wen I dey with una, but una dey obey well-well, even wen I nor dey with una). Make una kontinue to do God work with all una heart, so dat una salvashon go full well-well,
“Naw, make una obey God kon dey loyal as una dey woship am with betta mind. Make una forget di gods wey una grand-grand papa dey serve before-before for di oda side for di river and for Egypt and make una kom woship God.