I don choose am, so dat e go kommand en son and shidren-shidren sey make dem obey mi kon do wetin dey good and korrect. If dem obey mi, I go do evritin wey I promise am.”
David tell Solomon en pikin, “Make yu nor fear, but start di work with strong heart and nor let anytin stop yu. God wey I dey serve, go dey with yu. E nor go abandon yu, but E go stay with yu till yu finish di temple and evritin wey go dey inside.
But make una look well! Make una dey kareful, so dat una nor go forget wetin una don take una eyes si. As long as una dey life, make una nor let dis tins komot from una mind! Make una make sure sey una tell una shidren and grand-shidren about dis tins.
If una sey una nor won woship God, den today-today, make una choose who una go woship, weda na una grand-grand papa gods wey dey di oda side for di river, or Amor pipol gods wey dey di land wey una dey stay so. But for mi and my whole house, na di Oga awa God wi go woship and serve till wi die!”