E still tell us sey, make wi nor build house, plant anytin or buy any vineyard for awasef. E kommand us sey make wi dey stay for tent, so dat wi go fit stay for dis land wey wi dey stay like strenjas.
Weda wi like wetin God tok or not, wi go obey di Oga awa God wey wi sey make yu help us pray to. Bikos wi know sey, if wi obey am, evritin go dey well for us.”
Make una make sure sey una obey all di kommand wey I dey give una, so dat evritin go dey well with una and una shidren-shidren, bikos una do wetin dey good and betta for una Oga God eye.
If una obey all di laws and kommand wey I dey give una today, e go betta for una and una shidren. I dey give una dis kommand, so dat una go get long life for di land wey di Oga una God dey give una forever.
Make una honor una papa and mama, just as di Oga una God don kommand una, so dat una go get long life and e go dey well with una for di land wey E won give una.
Make una always dey do wetin dey rite and good for God eye, so dat evritin go dey well with una, den una go enter and stay for di good land wey God promise sey E go give una grand-grand papa.
Make una pay attenshon, Israel pipol, and dey kareful to do dis, so dat una go stay well kon plenty more-more – as God, una papa-papa Oga tell una and una go inherit di land where milk and honey plenty well-well.