Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Efesians 6:18 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

18 With difren prayers, make una dey ask God to help una. Make una always dey pray with di Spirit and dey shine una eyes well-well. Make una nor give up, but make una kontinue to pray for all God pipol.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Efesians 6:18
51 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Oga God, make Yu always dey favor Israel yor pipol and dia king, den hear dia prayer wen ever dem koll Yu for help.


Afta Solomon don pray to God finish, e stand for di altar front where e knee down and raiz en hand since.


Make awa Oga God remember all di prayer and komplain wey I don make with am since. Make E always dey show mesi to Israel pipol and dia king wen dem koll am evriday,


God tell am, “I don hear yor prayers. Dis temple wey yu build for mi, I don make am holy for mysef and na der dem go for woship mi forever. I go wosh and kare for am always.


E give Hatak one kopy for di kommand wey dem read for Shushan, sey make dem kill all Jew pipol. Mordekai sey make e go give and tell Estha evritin, so dat e go beg di king make e sorry for en pipol.


God go show dem en happiness? Dem go fit koll God anytime wey dem like?


My God, make Yu ansa mi wen I koll Yu. Na only Yu go fit diliver and free mi from wiked pipol and all my trobol. Make Yu sorry for mi kon hear my prayers.


God don hear as I dey beg; E go ansa my prayers.


God, wen wi dey pass thru pain, wi kry, pray and look for Yu, bikos of di way Yu dey ponish us.


Wen Daniel hear wetin happen, e kon go en house. E klimb go one room for up wey en window face Jerusalem. Just as e dey do before, e knee down for di window wey open kom pray give God and e dey do am three times evriday.


As I still dey pray, dey konfess and beg God make E forgive mi and Israel pipol sin kon sorry for en holy temple,


E fight with God angel kon win. E beg di angel make e bless am. E meet God for Bethel and God kon tok with am for der.


“Den I go pour my spirit to pray and to show mesi for David shidren-shidren body and di oda pipol for Jerusalem. Dem go dey look mi, di pesin wey dem shuk, den dem go mourn like pesin wey dey mourn en only pikin. Dem go kry well-well like sey na dia first boy pikin die.


Dis kind demon nor go gri komot from pesin body escept na with fasting and prayer.”


Open yor eye make yu pray, so dat yu nor go fall inside temptashon. Yor spirit won do am, but yor flesh dey weak.”


Make una dey wosh and shine una eye, bikos una nor know wen di time go rish.


Make yu nor sleep, but dey pray make yu nor for fall enter temptashon. Man spirit won pray, but en body dey weak.”


But make una dey shine una eye evritime, dey pray make God give una pawa take pass all dis test wey go happen, so dat una go fit stand for Man Pikin front.”


So Jesus tell dem, “Why una dey sleep? Make una get up pray, so dat una nor go fall enter temptashon!”


Naggai na Maat pikin, wey bi Mattatias pikin, wey bi Semein pikin, wey bi Josek pikin, wey bi Joda pikin.


Lamek na Metuselah pikin, wey bi Enoch pikin, wey bi Jared pikin and Mahalalel wey Kenan born, naim bi Jared papa.


Dem kon dey pray togeda evriday with one mind, with all di wimen, plus Mary, Jesus Christ mama and en brodas.


E dey holy and en and en family dey woship God. E dey help di pipol well-well and dey pray to God evritime.


So as Pita dey prison, di pipol wey dey di church dey pray to God for am, day and nite.


So dat wi go fit put awa mind for prayer, as wi dey prish God word.”


Make una let una hope give una happiness. Make una dey patient wen trobol kom and nor stop to pray.


Di Spirit wey God give us nor go make us fear like slave, instead, wi bi God shidren and wi dey koll am, “Awa Papa!”


Since wi bi God shidren, E put en Holy Spirit inside us and naim make us dey fit koll am, “Abba! Fada!”


I nor dey stop to tank God for una, wen ever I dey pray.


thru am, God don build una togeda as where E go dey stay thru di Spirit.


una go fit join all God pipol undastand how God love wide, long, high and deep rish.


Na mi small pass for all God pipol, but God don give mi grace to prish di Good News give Gentile pipol and dis grace wey Christ give mi, nor dey finish.


Make una pray for mi too sey, make God give mi betta word anytime wen I open my mout to tok and make I fit esplain di sekret wey dey di gospel.


Evritime wen I dey pray for una, I dey do am with happiness,


Make una nor let anytin worry una for mind. Instead, for evry kondishon wey una dey face, make una ask God thru prayer for evritin wey una nid and make una always dey tank am, as una dey pray.


Wi dey always tank God wey bi Jesus Christ Papa, anytime wen wi dey pray for una,


since wi hear about how una bilive Christ and di love wey una get for God pipol.


Make una dey sirious for una prayer. Make una dey shine una eye as una dey tank God wen una dey pray.


First of all, I tell una make una dey pray, ask and tank God for evribody.


Anytime I remember yu for my prayer, weda na for nite or day time, I dey always tank God wey I dey serve with betta mind, just as my grand-grand papa dem serve am.


bikos I don hear about di faith and love wey yu get for awa Oga God Jesus Christ and all God pipol,


Wen Jesus still dey dis eart, e pray and kry to God wey go save am from deat. God hear en prayers, bikos e obey God for evritin.


Di time wen evritin go end don near. So make una dey kontrol unasef and shine una eye wen una dey pray.


My friends, make una dey build unasef up with faith wey holy well-well and dey pray with di Holy Spirit.


As Hannah still dey pray give God, Eli kon dey look en mout.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ