16 and with all dis, make una karry faith wey go help una kwensh all di wiked arrows wey Satan dey trow.
Afta all dis tins, God tok to Abram for vishon: “Abram! Make yu nor fear! Na mi dey guide yu and yor reward go big well-well.”
My Oga God! Yu protet and save mi; Yu don make mi great.
Dem go shuk una with sharp arrow kon burn una with hot shako from fire.
E go ready en swod wey dey kill kon shot en arrow wey dey hot like fire.
God name na strong place to hide put, raitious pipol dey run enter and dem dey-dey save.
Wen yu sey, ‘Yes,’ make yu mean am and wen yu sey ‘No,’ make yu mean am too. Any oda tin wey yu tok pass dis, na devil e from kom.”
Wi nor dey try to force una to bilive us; wi know sey una faith strong well-well. But wi dey work with una so dat una go dey happy well-well.
Make una nor drive God Spirit komot for una life.
But since wi bilong to lite, make wi dey kwayet, use faith and love take protet awa chest, den wear di hope wey wi get like priest kap for head.