Si as e dey good to si messenja wey dey kom give una peace and good news from di mountins! E dey announce sey una don win kon tell Zion pipol sey, “Una God na king!”
God wey get pawa dey give mi strent. E make mi stand strong for groun like deer kon keep mi save on-top di mountin. (For di kwayamasta: Make dem sing dis song with instrument like, jita.)