9 bikos di fruit wey lite get, dey bring goodness, raitiousness and trut.
Naw, make una do wetin go show sey una don turn from sin kom meet God,
Wen Jesus si Netanel dey waka kom meet am, e kon sey, “Make una look! Dis na betta pesin wey kom from Israel, wayo nor dey en belle.”
My friends, I dey sure sey una dey good; know God well-well and fit tish one anoda.
May bi una dey take God kindness, patient and endurance as yeye tins. Una nor know sey God dey kind, bikos E wont make una turn from sin kom meet am?
But, as wi dey do wetin dey good and korrect with love, wi go dey grow for evry side kon meet Christ wey bi di head.
Since una don stop to lie, make una start to tok trut give una neighbour, bikos all of us na membas for Christ body.
So, make una stand well-well kon tie trut like belt round una waist, den wear bullet proof koat as raitiousness for una body.
Make di work wey Christ do for us and how to please God, full una mind. Den all di glory and praiz go bi God own.
Una wey bi wife, make una dey do wetin una husband wont, as Christ pipol suppose do.
But yu wey dey serve God, make yu nor put hand for all dat kind tin. Instead, make yu dey struggol to do wetin dey rite and good; dey keep yor promise; dey love; get patient and dey gentol.
but koncerning en pikin, E sey: “Yu bi God! Yor kingdom go dey forever and ever and yu go rule yor pipol with authority.
na faith dem take win kingdoms; do wetin good for God eye; kon get di tins wey God promise dem; klose lion mout;
If una know sey E dey raitious, den una go know sey, doz wey dey do wetin God wont, na en shidren dem bi.
My friend, make yu nor follow bad tin, but do wetin dey good. Di pesin wey dey do good, na God own and di pesin wey dey do wetin bad, neva know God.