Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Efesians 5:6 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

6 Make una nor let anybody deceive una with yeye word, na dis tins make God dey vex for doz wey nor dey obey am.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Efesians 5:6
28 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

To dey boast sey yu don plan well to fight mi, nor mean anytin. Na who dey give yu mind sey yu fit fight mi?


God kon dey vex for dem and E kill all dia strong-strong men. E kill Israel yong men wey fine pass.


Nor listin to anybody or profet wey sey e know wetin go happen tumoro; doz wey dey undastand dream; doz wey dey koll dead body or doz wey dey do majik; wey sey make una nor respet Babilon king.


“Send message go give all di prisonas for Babilon about Shemaya. Mi wey bi God, go ponish Shemaya and all en shidren-shidren. I nor send am, but e tok to una as if en na profet and e make una bilive di lie wey e tell una.


So mi wey bi God dey warn una naw sey, make una nor deceive unasef sey Babilon sojas nor go kom back kon attack una, bikos dem go really kom back.


Dis na wetin God tok: “Una wey bi lie-lie profets dey make my pipol sin! If pesin give una food chop, una go sey make peace dey with am, but doz wey nor give una, una go won fight dem.


Lie-lie messiahs and profets go kom do big-big mirakles take deceive pipol. If e possibol sef, dem go deceive pipol wey God choose.


Jesus ansa dem, “Make una shine una eye, so dat nobody go fit deceive una.


Bikos fake christs and profets go kom and dem go do signs and mirakles wey bi like majik to deceive pipol. If to sey e possibol, dem go deceive di pipol wey God don choose.


Jesus ansa dem, “Make una take kare, so dat nobody go deceive una.


Bikos of all di sins and bad tins wey wiked pipol dey do, God vexnashon dey show from heaven and di sins dey kover di trut.


Make una nor let doz wey dey pritend and woship angels judge una. Dat kind pesin dey tok anyhow about vishon wey e sey e si, but na yeye tins and sin full en mind.


I dey tok all dis tins, so dat nobody go dey deceive una with argument.


Make una take kare and nor let anybody fool una with wayo tok about human being wisdom and spiritual pawas wey dey rule di world, but make una dey do as Christ wont.


Na dis tins dey make God vex for doz wey nor dey obey am.


Make nobody deceive una. Bikos dat day nor go kom until trobol go first kom and true-true, di pesin wey God go distroy, go kom out.


Make una nor let difren-difren prishin wey una nor know turn una head. Una spiritual pawa dey kom from God grace, nor bi from food wey dem sakrifice, bikos di sakrifice nor fit help pipol wey dey do am.


So for dat time, doz pipol nor enter di land wey God promise dem, bikos dem nor bilive am.


Na-im bi di rock wey dey fall pipol, bikos dem nor fit jump am pass. As dem nor bilive God word, dem bigin fall, bikos na so E plan sey e go bi.


My friends, make una nor bilive evribody wey sey na God Spirit dey tok thru am. Una must test am to know weda na God Spirit e really get. Bikos many fake profets dey for dis world.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ