Bikos di Pesin wey kreate una, go bi una husband. Na God wey get pawa bi en name. Israel God wey dey holy go save una. Dem dey koll am di God of di whole eart.
Di pesin wey won marry new wife naim bi di bridegroom. En friend, wey bi di best man, dey listin to am. E go dey happy well-well wen e hear di bridegroom dey tok. Na dis dey make mi happy and my joy don full.
Wetin I wont bi sey, wen una don really undastand God sekret wey dey inside Jesus Christ, make una heart dey strong with love, so dat una go get evritin wey una wont.
Wi know sey God ways dey great well-well: Christ kom as human being; di Spirit show sey e dey free; angels si am wen e kom prish among Gentile pipol; pipol bilive am for di world and God karry am go heaven with glory.