24 As di church dey submit to Christ, na so too, wife suppose submit to dia husband for evritin.
“Make una do evritin wey I tell una and una nor go pray or swear to any oda god. Make I nor ever hear dia name for una mout.
“Yu go anoint Aaron and en sons for seven days, just as I kommand yu.
Di seventy-two men kon kom back with happiness, dey sey, “Oga God, even demons dey obey us wen wi kommand dem with yor name!”
bikos na di husband bi di wife head, just as Christ bi head for di church and naim en save di body.
Husband, make una love una wife, just as Christ love di church kon sakrifice en life for am,
So, each man suppose love en own wife, just as e love ensef and evry wife suppose respet en husband.
Una wey bi pikin, make una dey obey una papa and mama for evritin, (dey do evritin wey una papa and mama tok), bikos na wetin Christ like bi dat.
Una wey bi savants, make una obey una mastas (dey do wetin dem tok) for evritin and nor bi only wen dem dey look una. Make una nor dey do like pipol wey wont make dem praiz dem, but make una dey obey with betta mind, bikos una dey fear God.
and make yu yorsef bi good ezample to dem. Make evritin wey yu dey do, show sey wetin yu dey tish, na trut.
Una wey bi savant, make una dey do evritin wey una oga wont and wen una oga tok to una, make una nor dey ansa am anyhow.