Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Efesians 5:21 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

21 Bikos of di respet wey una get for Christ, make una dey respet one anoda.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Efesians 5:21
20 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Den di angel tell am, “Go back go meet yor madam make yu respet am.


All di ofisas, sojas and even David oda shidren kon promise sey dem go respet am as dia king.


Make una respet God as una dey take decision, bikos di Oga wey bi awa God nor dey like wayo, bribe or anyhow tins.”


All di govnors wey don rule before mi, trobol di pipol and dey kollect forty silva koins evriday for food and wine. Even dia savants dey opress di pipol too. But I difren from dem, bikos I dey fear God.


Den I sey, “Wetin una dey do so nor good! Una nid to respet God and dey do wetin korrect. Den una nor go give awa enemies wey bi Gentile pipol, any shance to laf us.


So my pikin, make yu fear God and honor di king. Make yu nor do anytin with pipol wey dey tok against dem,


dey obey dis leaders and doz wey dey follow una do God work.


So, bikos wi know wetin e mean to fear God, naim make us dey prish and beg pipol. But God know us well-well and I hope sey una know us well-well for una mind too.


So, as God don promise us all dis tins, make wi wosh awasef komot from evritin wey go fit make awa body or awa soul dirty, so dat wi go dey holy as wi dey respet God.


My brodas and sistas, God don koll una make una dey free; but make una nor use di freedom wey God give una anyhow, instead make una love each oda.


Una wey bi wife, make una dey respet una husband, just as una dey respet Christ,


As di church dey submit to Christ, na so too, wife suppose submit to dia husband for evritin.


Make una nor dey karry body up, but make una trit each oda like unasef. Instead, una dey do wetin una like, bikos of di tins wey una go gain, so dat una go fit boast.


Make wimen dey kwayet and listin well as dem dey learn.


E must bi pesin wey dey manage en own house well and dey make en shidren obey and respet am.


Make una obey una leaders and do evritin wey dem tok, bikos na dem dey kare for una soul and dem go ansa God wen E ask dem how dem do dia work. Make una let dem do am with happiness, nor bi with komplain, bikos una nor go get any betta tin from am.


Make una dey obey una leaders bikos of Christ. Weda dem bi kings wey get pawa


Make una respet evribody. Love dis awa family wey bilive Christ. Make una fear God and respet di king.


For di same way, make una wey yong put body down for di eldas. Make una nor dey karry body up for each oda, bikos God dey oppoz proud pipol, but E dey favor doz wey dey honbol.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ