But wen David don kount di pipol finish, en heart kon dey judge am, den e tell God, “I don kommit big sin for dis tin wey I do! Abeg, make Yu forgive mi. Na foolish tin I do so.”
But Job tell en wife, “Wetin make yu dey tok anyhow! Wen God give us good tins, wi take am. So naw wey trobol dey, make wi kon curse am?” Even as all dis tins dey happen so, Job nor sin or curse God.
Wen Pilate si sey di pipol nor gri and trobol won start, e kon take wota wosh en hand for di pipol front dey sey, “Dis man blood nor dey my head. Make only una go kill-am!”
My brodas and sistas, make una stop to tink like small shidren. Instead make una dey tink like mature pipol and dey innocent like pikin wey dem just born.
Make una life dey show sey una bilive Christ message, so dat weda I kom si una or not, I go dey hear sey una dey strong with one spirit, one mind and dey fight togeda make di gospel for stand.
Bikos of dis, wi too, since wi hear about una, wi neva stop to dey pray for una. Wi dey tell God make E show una wetin E wont, so dat una go dey wise and undastand God Spirit,
Make sure sey una dey obey di Pesin wey dey tok to una! Bikos if Israel pipol wey nor gri hear dia oga Moses word for eart nor eskape, how wi go fit eskape, if wi nor gri hear di Pesin wey dey tok to us from heaven?
So, I kon bow make I for woship di angel, but e sey, “Nor do dis tin! I bi savant and broda like yu wey whole di trut about Jesus well. Make yu woship only God, bikos na di profesy spirit bi di true word about Christ.”