Efesians 5:14 - Holy Bible Nigerian Pidgin English
14 Bikos na lite dey make evritin shine kom out and na dis make dem rite sey: “Wake-up; yu wey dey sleep! Make yu raiz from grave and Christ go shine for yor life!”
God pipol wey don die, go kom back to life! Dia body go raiz-up again. So, all of una wey dey grave, make una wake-up kon shaut with happiness, bikos una go grow well like grass wey dew fall put and di eart go bring back evritin wey don die.”
Jerusalem, make una wake-up! Make una karry unasef up! Una don drink from di ponishment cup wey God give una, bikos E dey vex. Una drink am and e dey make una stagga.
Jerusalem pipol, make una dey great and strong again! God holy town, make una wear pride like klot! Pipol wey nor know God nor go enter una gate again.
Make una nor let Satan use una body take do bad tins, but make una karry unasef give God as pipol wey don wake-up from deat, so dat una go dey do good tins.
Bikos God wey sey, “Make lite shine from darkness,” Na-im dey shine inside awa heart, so dat E go give us di lite wey show us en glory wey dey Christ face.
Den dia sense go korrect and dem nor go fall enter devil trap again. Bikos devil don katch dem put inside en trap before, so dem dey do anytin wey e wont.