Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Efesians 4:9 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

9 Na wetin dis word, “E raiz-up,” mean? E mean sey Christ first die and dem beri am for di eart.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Efesians 4:9
22 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Den Oga God kom down kon si di town wey doz men dey build,


my bones nor hide from Yu, even wen Yu make mi for sekret kon put mi for di eart.


But distroshon go follow doz wey dey plan to distroy mi. Dem go die go where dead body dey.


Yu make dem bi like Yu kon give dem glory and honor.


God kom on-top di mountin kon sey make Moses kom meet am for der, so Moses kon go up.


Who don go heaven kom back? Who don ever katch breeze for en hand or wrap wota for klot? Who kreate di whole world? Na who e bi and na wetin bi en pikin name? Make yu tell mi, if yu know!


Heavens, make una shaut dey happy! All di deep part for dis eart, make una shaut well-well! Make mountins and evry tree for di forest, shaut too, bikos God protet Israel pipol kon show how E great rish.


So from naw go, no matter how dem wota any tree rish, e nor go grow kon tall rish di kloud again. All of dem must die like man pikin, dem must die go where dead body dey.’ ”


As Jonah dey inside big fish belle for three days and nites, na so Man Pikin go dey for grave for three days and nites too.


Jesus ansa am, “Make yu neva tosh mi, bikos I neva go meet my Papa for heaven. Go meet my brodas, tell dem sey, ‘I dey go heaven go meet my Papa, wey bi yor Papa too; my God, wey bi yor God too.’ ”


Nobody don go heaven before, escept Man Pikin wey kom down from heaven and e go-go back der.


God bread na di pesin wey kom down from heaven kon give betta life to di pipol wey dey dis world.”


Nor bi to do wetin I wont make mi kom down from heaven, but na to do wetin my Papa wont.


Den di Jew pipol bigin vex and komplain about Jesus, bikos e tok sey, “Na mi bi di bread wey kom down from heaven.”


Na mi bi di bread wey kom down from heaven. Anybody wey chop dis bread go live forever. Na my flesh bi di bread wey I go give di pipol wey dey for dis world.”


Dis na di bread wey kom down from heaven, e nor bi like di bread wey una grand-grand papa dem chop and afta, dem still die. Di pesin wey go chop dis bread nor go ever die, but e go live forever.”


Wetin go happen if una si Man Pikin go back to heaven where e dey before?


Jesus ansa dem, “Even if I dey tok about mysef, wetin I dey tok na true, bikos I know where I from kom and where I dey go. But una nor know where I from kom or where I dey go.


Aldo yu make angels high pass am small. But yu kon gi-am honor and glory.


even doh wi si Jesus wey angels big pass small, e nor too tey before God gi-am glory and honor, bikos e sofa and die for evribody, just as God plan am.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ