Nor bi di same papa all of us get? Nor bi di same God kreate all of us? Den why wi dey break awa promise wey wi make to each oda kon hate di kovenant wey God make with awa grand-grand papa dem?
Jesus ansa am, “Make yu neva tosh mi, bikos I neva go meet my Papa for heaven. Go meet my brodas, tell dem sey, ‘I dey go heaven go meet my Papa, wey bi yor Papa too; my God, wey bi yor God too.’ ”
But wi (wey bi Christian), na only one God wi get and naim bi awa Papa. Na-im kreate evritin and wi dey live for am. Na Jesus Christ bi awa only Oga God. Na-im make evritin and na thru am wi get life.
Wish kind business God Temple and juju get? Bikos wi bi God Temple, just as God sey, “I go stay inside dem and waka among dem, den, I go bi dia God and dem go bi my pipol.”
di place wey far well-well, wey high pass where wiked pipol dey rule; wey strong pass evry pawa wey dey dis world; big pass evry name wey dey for dis world and di ones wey dey kom.
So anybody wey do all wetin God tok, dey inside am and God dey inside dat pesin too. Wi know sey E dey inside us, bikos di Spirit wey E give us, dey stay inside us.