To God holy pipol for di church wey dey Korint, wey bi en own bikos of Jesus Christ and pipol for evriwhere wey dey woship awa Oga God Jesus Christ as dia Oga God and Savior.
Some pipol among us na Jew and odas na Gentile. Some na slave and odas dey free. But God Spirit baptize us kon make us part for Jesus Christ body. Naw, all of us dey drink from dat same Spirit.
But wi (wey bi Christian), na only one God wi get and naim bi awa Papa. Na-im kreate evritin and wi dey live for am. Na Jesus Christ bi awa only Oga God. Na-im make evritin and na thru am wi get life.
So, if anybody kon prish anoda Christ wey wi nor prish for una and una receive anoda spirit wey una nor receive before, or anoda gospel wey una neva hear before, dat mean sey, una don asept dem well.
Nor bi only doz ones, but naw, I dey look evritin as nor-tin, wen I kompare am with Christ, my Oga God wey I know and I trowey evritin, bikos of am. True-true, I dey look all doz tins as yeye, so dat I go fit gain Christ,
Na Paul, wey bi Jesus Christ apostle and God savant rite dis leta to help pipol wey God don choose, so dat dia faith go strong kon know di trut wey go help dem live di kind life wey God wont.
Dis show how baptizim go save us, nor bi just to wosh dirty komot for pesin body, but na to show sey wi get good mind for God thru di way wey Jesus Christ take raiz-up
Na mi Pita wey bi Jesus Christ savant and apostle, rite dis leta to di pipol wey get di same faith wey wi get. God give una dis faith, bikos of en raitiousness wey kom thru awa Oga God and Savior, Jesus Christ.
My friends, even doh e don dey hongry mi since to rite give una about di salvashon wey wi dey share togeda, naw e strong well-well for my mind to rite, so dat una mind go dey strong. So una go fit stand fight for wetin wi bilive; di tins wey God don give en pipol and nor-tin go fit shange am.