All dis yor savants go kom meet and bow for mi sey, ‘Make yu and all di pipol wey dey follow yu komot for here’ and afta dis, I go komot for here too.” With vexnashon, Moses kon waka leave Fero.
But I tell una, anybody wey vex for en broda, God go judge am too. Anybody wey curse en broda, go face di kansol and anybody wey koll pesin, ‘Mumu’, go-go hell-fire.
But wen Jesus si wetin dey happen, e vex kon tell en disciples, “Make una allow small-small shidren kom meet mi, nor stop dem, bikos na pipol like dem, go enter God Kingdom.
So Jesus vex kon look dem round, bikos dia heart strong well-well, den e tell di man, “Stresh yor hand.” So di man stresh en hand and di hand kon well again.
Una must pay dem for dia work evriday wen evening rish, bikos dem poor and dey wait dat money. If una nor pay dem, dem fit kry give God and di sin go dey una head.