Naim bi di Spirit wey dey tok trut, wey pipol for dis world nor go fit receive, bikos dem nor fit si am or know am, but una know am, bikos e dey stay inside una.
How dem won take koll God make E help dem, wen dem nor bilive am? And how dem go fit bilive, wen dem neva hear about am? How dem go take hear about am, if nobody prish to dem?
kom meet una. Dis gospel dey bear fruit for di whole world and since di day wey una hear am, una don undastand as God grace big rish and e don dey bear fruit and grow among una.
Wi know sey God Pikin don kom and e don give us sense to know di trut about God. And wi dey inside en Pikin Jesus Christ. Na-im bi di real God and na-im bi di life wey nor go end.