Na mi bi di high and holy God, di Pesin wey go live forever. Where I dey stay, dey high and holy, but I still dey stay with pipol wey dey honbol and ready to turn from sin kom meet mi, so dat I go give dem mind and hope again.
Una wey dey honbol, make una ask make God bless and help una to follow en kommand. Make una do wetin dey rite and live betta life. May bi God go protet and save una from en vexnashon, wen E won distroy di world.
Zion pipol! Make una happy well-well! Jerusalem pipol! Make una shaut with joy! Make una look, una king dey kom meet una! E dey raitious and naim get viktory. E dey honbol and kwayet as E sidan on-top donkey dey kom.
But yu wey dey serve God, make yu nor put hand for all dat kind tin. Instead, make yu dey struggol to do wetin dey rite and good; dey keep yor promise; dey love; get patient and dey gentol.
So make una remove una hand from evry dirty and wiked tins kon put una body down to asept God word wey dem don plant inside una, bikos e get pawa to save una soul.