Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Efesians 4:11 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

11 Na Christ make some among us bi apostles, profets, evangelist, pastors and tishas.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Efesians 4:11
19 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

For sometaim naw, Israel pipol nor get di true God or priest wey go tell dem di law or wetin to do.


I go give una kings wey go obey mi and dem go rule una with wisdom and undastandin.


dey tish dem to do evritin wey I tish una. I go always dey with una until di world go end.”


Dis na di profets and tishas wey dey di church for Antiok: Banabas, Simeon wey dem dey koll Naija, Lucius wey kom from Sirene, Manaen (wey bi Herod di Tetrak friend from small pikin) and Saul.


Make una take kare of unasef and all di pipol wey di Holy Spirit don put under una, bikos na una bi di leaders for God church wey E buy with en only pikin blood.


Di next day, wi leave der kon go Caesaria. For der, wi enter Filip house. Dis Filip na evangelist and e dey among di seven deakons wey dem choose for Jerusalem, den wi kon stay der with am.


If wi dey serve odas, make wi serve dem well. If wi dey tish, make wi tish well.


Na many spiritual gifts God dey give pipol, but all of dem na from di same Spirit.


Dis na bikos, God don build una on-top di apostles and profets foundashon and na Jesus Christ bi di nomba one stone wey God take lay di foundashon.


Di pipol wey dey before nor know dis sekret as God don show en holy apostles and profets wey dey naw, thru di Holy Spirit.


Na dis make dem sey, “Wen e raiz-up go heaven, E karry many prisonas wey E free follow body and E give plenty gift to pipol.”


But make yu kontrol yorsef for evritin. Nor fear to sofa for Christ. Dey do God work and dey tell odas about di Good News.


E don tey wen una bi Christian, so by naw, una suppose to dey tish odas. Instead, una still wont make pesin kom tish una di first tin wey dey God word. Una still dey drink milk, instead of una to dey chop solid food.


But my friends wey I love, make una remember wetin awa Oga God Jesus apostles tell una.


Evribody wey dey heaven, God pipol, di apostles and profets, make una happy bikos God don judge and kondemn am bikos of una!”


Di town wall get twelf foundashon and dem rite di Lamb twelf apostle name put for di twelf foundashon.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ