Dat time, di church wey dey Judea, Galilee and Samaria get rest and dis kon make dem strong as dem dey stay togeda, dey woship God with all dia heart and as di Holy Spirit dey tok to dem. So pipol wey dey di church kon dey plenty more-more.
My brodas and sistas, God dey good. So Abeg, as una dey alive, make una dey offa una body gi-am as sakrifice. Make una dey do wetin E tok and wetin go make belle sweet am. Na dis bi di best way to serve God.
Make una life dey show sey una bilive Christ message, so dat weda I kom si una or not, I go dey hear sey una dey strong with one spirit, one mind and dey fight togeda make di gospel for stand.
Epafras, wey bi one among una and Christ savant, dey greet una. E dey pray well-well for una, so dat una leg go strong for groun and una go grow as una dey learn di tins wey God wont.
Na dis make us dey always pray for una sey, as God koll una, E go make una dey good and evry good tin wey una wont, go happen to una thru en pawa, so dat una work wey una dey do with faith, go komplete.
Bikos God save and koll us to live holy life. E do like dis, nor bi sey wi deserve am bikos of wetin wi do, but na so E plan am even before di world start, so dat wey go know en grace thru Jesus Christ.
make E give una evritin wey una nid to do wetin E wont. Anytin wey good for en eye, make E do am inside us thru Jesus Christ. Make all glory bi Jesus Christ own forever and ever. Amen!
I pray make God pawa give us evritin wey wi nid, so dat wi go fit live di kind life wey E wont, as wi don know di trut about Jesus wey koll us with en glory and goodness.