I go send profets, wise pipol and law tishas kom meet una and una go kill and nail some for cross, flog some inside una sinagog, den porshu di odas from one town go anoda.
I tell una true word, ‘Many profets and kings don try to si wetin una dey si so, but dem nor fit si am and dem don won hear wetin una dey hear so, but dem nor fit hear am.’ ”
But di pesin wey go help una na di Holy Spirit, wey my Papa go send kom for my name. E go tish una evritin and e go help una remember evritin wey I don tell una.
E tell dem, “Una know sey di law nor allow us, wey bi Jew pipol, to visit Gentile pipol or follow dem do anytin, but God don show mi sey make I nor sey anybody nor dey klean.
Make wi praiz God, bikos e don make una strong thru dis Good News wey I dey prish about en pikin, Jesus Christ. For many years naw, dem keep dis message for sekret,