So kworel kon start between dem and some oga for di law matter wey bi Farisee pipol kon stand up dey oppoz di Sadusi pipol sey, “Wi nor si any bad tin wey dis man do. Una know weda na spirit or angel tok to am?”
My friends, I nor won make una dey boast about unasef. So I go tell una wetin happen to Israel pipol. Some among dem sturbon well-well and na so dem go bi until di nomba for Gentile pipol wey God wont, don komplete.
Make wi praiz God, bikos e don make una strong thru dis Good News wey I dey prish about en pikin, Jesus Christ. For many years naw, dem keep dis message for sekret,
So, bikos of di gospel, Gentile pipol don follow Jew pipol get share for God blessing. Dem don bi membas for Christ body and dem get share for God promise.
Wetin I wont bi sey, wen una don really undastand God sekret wey dey inside Jesus Christ, make una heart dey strong with love, so dat una go get evritin wey una wont.
I tell my dear broda Silas sey, make e help mi rite dis small leta, so dat una heart go strong and make e tell una sey, all wetin dey happen to una, na as God wont am. So make una stand strong with en pawa.