Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Efesians 3:2 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

2 True-true, una don hear sey na God give mi dis work thru en grace and na for una own good.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Efesians 3:2
27 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

As dem dey fast and woship God, di Holy Spirit kon tell dem, “Make una separate Banabas and Saul for di work wey I wont make dem do.”


Paul and Banabas kon use boldness take ansa dem, “E good sey na una wi first prish God word give. But since una rijet am and una nor ready to get life wey nor dey end, wi go-go prish give Gentile pipol.


But di Oga God sey, ‘Go, bikos I go send yu go far-far go meet Gentile pipol.’ ”


But God tell Ananias, “Make yu go meet am, bikos I don choose am make e karry my name to Gentile pipol, kings and all Israel pipol.


Na thru am, God give us favor and pawa to bi apostles and na dis pawa wi dey use take dey koll Gentile pipol, make dem obey and bilive en name.


Naw, I dey tok to una wey bi Gentile pipol and as long as I bi una apostle, I dey happy with di work wey I dey do,


By di grace wey God give mi, I dey tell all of una, make una nor tink sey una too dey important. Instead, make una use good sense tink and undastand di faith wey God give una.


Make una dey tink about us as Christ savant wey God don show en sekret.


Una don hear about di kind life wey I dey live before as Jew pesin; how I trobol di church kon dey try to distroy am.


God go komplete en plan wen di time don rish, den E go gada evritin wey dey heaven and eart togeda under Christ, wey bi di head.


I bi dis gospel savant, bikos of God grace wey E give mi thru di work wey en pawa dey do.


Na mi small pass for all God pipol, but God don give mi grace to prish di Good News give Gentile pipol and dis grace wey Christ give mi, nor dey finish.


Di grace na to make evribody undastand God sekret plan. Na God kreate evritin and E hide di plan since e kreate di world.


If na thru, den una don hear and learn di trut about am, just as di trut dey inside Christ.


But God don give grace to all of us akordin to how Christ gift plenty rish.


since wi hear about how una bilive Christ and di love wey una get for God pipol.


kom meet una. Dis gospel dey bear fruit for di whole world and since di day wey una hear am, una don undastand as God grace big rish and e don dey bear fruit and grow among una.


wey dey dis betta gospel, wey awa Oga God sey make I dey prish.


but dey waste oda pipol time with di words wey dem dey tok. Dis kind tin dey make pipol live yeye life, instead of to dey hear God word wey dey make pesin faith strong.


Na dis tins make God choose mi as prisha, apostle and tisha to Gentile pipol, so dat I go prish faith and wetin bi trut (na true word I dey tell una so, I nor dey lie).


Na dis gospel make God choose mi as prisha, apostle and tisha.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ