Na mi bi di high and holy God, di Pesin wey go live forever. Where I dey stay, dey high and holy, but I still dey stay with pipol wey dey honbol and ready to turn from sin kom meet mi, so dat I go give dem mind and hope again.
E bi like man wey dey build house, wey dig groun kon lay di foundashon on-top strong rock. Wen big wota rush kom, e nor go fit shake di house, bikos dem build am for betta rock.
Naim bi di Spirit wey dey tok trut, wey pipol for dis world nor go fit receive, bikos dem nor fit si am or know am, but una know am, bikos e dey stay inside una.
I dey with dem and yu dey with mi, so dat dem go really bi one, just as wi bi one and di world go know sey na yu send mi and yu love dem, as yu love mi.
For di leta wey una rite, una ask mi about juju food. And all of us know sometin koncerning dis matter. But if wetin wi know, dey make us dey proud, den bikos of love, wi suppose help one anoda.
Make una test unasef to know weda una still dey inside di faith; e good make una shek unasef well-well! Una nor know sey Christ dey inside una? May bi una don fail di test!
Wish kind business God Temple and juju get? Bikos wi bi God Temple, just as God sey, “I go stay inside dem and waka among dem, den, I go bi dia God and dem go bi my pipol.”
I don die with Christ for cross, so nor bi mi dey live again, but na Christ dey live inside mi. Di life wey I dey live naw, na bikos of di good tins wey God pikin do inside mi, bikos e love and die for mi.
If true-true una get faith and una leg strong for groun, den una go get hope kon whole di gospel wey una hear. Dem don prish dis gospel give evribody for di world and mi Paul don bi di gospel savant.
God wont make dem know di rishis wey dey en glory; wey di sekret get for evribody and na-im bi Christ wey dey inside una. So una get hope sey una go share for God glory.