Wen di Gentile pipol hear wetin e tok, dem start to happy kon dey tank God for en word and evribody wey God don choose to get life wey nor dey end, kon bilive.
na Judas sell dis man give Jew pipol, bikos na so God plan am from biginnin. Una know sey una kill-am, wen una gi-am to di sojas make dem nail am for cross.
My friends, I nor won make una dey boast about unasef. So I go tell una wetin happen to Israel pipol. Some among dem sturbon well-well and na so dem go bi until di nomba for Gentile pipol wey God wont, don komplete.
God wise well-well, so E nor let pipol for dis world know am with di wisdom wey dem get. Instead, E save only di pipol wey bilive di foolish message wey wi dey prish.
Wi know sey God ways dey great well-well: Christ kom as human being; di Spirit show sey e dey free; angels si am wen e kom prish among Gentile pipol; pipol bilive am for di world and God karry am go heaven with glory.
Bikos God save and koll us to live holy life. E do like dis, nor bi sey wi deserve am bikos of wetin wi do, but na so E plan am even before di world start, so dat wey go know en grace thru Jesus Christ.