Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Efesians 1:4 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

4 Before God kreate di world, E choose us thru Christ bikos E love us, so dat for en front, wi nor go get any fault and wi go dey holy.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Efesians 1:4
55 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

E know sey I nor get fault and I nor dey do bad tins.


True-true, God don choose Jakob as en own and Israel pipol as en own pipol.


God sey, “Na my savant wey I give pawa bi dis; di pesin wey I choose and I dey happy with am. I don put my Spirit inside am and e go judge di nashons well.


“Make yu tell Israel pipol sey, ‘Una must dey holy, bikos mi wey bi Oga una God, dey holy.


“ ‘Make una keep unasef holy, bikos na mi bi di Oga una God.


And if God nor reduce di days wen dis tins go happen, evribody go die finish. But bikos of di pipol wey God choose, e go reduce di days.


Lie-lie messiahs and profets go kom do big-big mirakles take deceive pipol. If e possibol sef, dem go deceive pipol wey God choose.


God go send en angels go blow loud trumpet and dem go gada di pipol wey E choose from evriwhere for di world.”


“Den di king go tell di pipol wey dey en rite hand, ‘Make una kom, una wey my Papa don bless and make una inherit di kingdom wey God prepare for una before di world start.


I get oda sheep wey nor dey here. I must gada dem too and dem go listin to my vois, all of dem go dey togeda and na one shepad go lead dem.


Nor bi una choose mi, but na mi choose una. Bikos of dat, I don give una pawa to bear fruit wey go last, so dat my papa go give una anytin wey una ask am for my name.


Papa, I wont make di pipol wey yu give mi stay with mi for where I dey, so dat dem go si di glory wey yu give mi, bikos yu love mi before yu kreate di world.


Wen di Gentile pipol hear wetin e tok, dem start to happy kon dey tank God for en word and evribody wey God don choose to get life wey nor dey end, kon bilive.


I dey for yor side and nobody go fit do yu anytin, bikos I get plenty pipol for dis town.”


Who go fit akuiz pesin wey God don choose? Na God know who good or bad.


God go help una rish di end, so dat E nor go si fault for una life for di day wen Jesus go kom back.


My brodas and sistas, God don koll una make una dey free; but make una nor use di freedom wey God give una anyhow, instead make una love each oda.


But di fruit wey di Holy Spirit dey bear inside us; na love, joy, peace, patient, kindness, goodness, faithfulnes,


For Christ, e nor matter weda dem sekonsaiz pesin or not; di only tin wey matter, na faith wey dey work thru love.


God kreate us thru Jesus Christ as di good work wey E don prepare down before, so dat wi go dey do as E plan.


So dat Christ go dey inside una heart thru faith and wen una don strong well-well inside God love,


Make una dey get pity for one anoda with kwayetnes, gentolness and patient, bikos of di love wey una get.


Make wi love one anoda, just as Christ love and sakrifice ensef as ofrin wey get betta smell to God, bikos of us.


E do like dis, so dat di church go bi like wife wey fine well-well, wey nor get any stain, dey do anyhow or get any oda tin wey fit spoil am.


so dat una nor go get any blame and una go dey klean. God Pikin nor get fault; even doh una dey live for di world wey bad pipol dey, una go dey shine like stars,


But naw, with en pikin blood, E don draw una klose kom en present, so dat E go make una en friends wey nor get stain or fault and wey dey holy.


Wetin I wont bi sey, wen una don really undastand God sekret wey dey inside Jesus Christ, make una heart dey strong with love, so dat una go get evritin wey una wont.


So, as pipol wey God don choose, wey holy and wey E love well-well, make una kwik dey sorry for pipol; dey gentol; nor dey karry body up and wear patient like klot for body.


Make Christ make una love for each oda and for evribody, grow more-more and big, just as awa love for una bi,


Bikos God nor koll us to live yeye life, but na to live holy life.


Bikos God save and koll us to live holy life. E do like dis, nor bi sey wi deserve am bikos of wetin wi do, but na so E plan am even before di world start, so dat wey go know en grace thru Jesus Christ.


So I dey ready to bear di sofa, as long as e go save doz wey God don choose inside Christ with glory wey go dey forever and ever.


But God strong foundashon still stand and dem rite put sey, “God know en pipol and evribody wey bi Christ own, must stop to do evil.”


My brodas and sistas, make una listin! God nor choose poor pipol for dis world sey, make dem rish for faith and inherit di kingdom wey E promise sey E go give doz wey love am?


make dem dey holy thru en Spirit. Make una dey obey Christ for evritin and en blood go klean una. Make grace and peace bi una own!


God choose am before E kreate dis world, but na for dis last days E show am to una.


But God don choose una to bi en priest and holy pipol, so dat una go prish di Good News, bikos E koll una from darkness kon enter en brite lite.


So, my friends, as una dey wait for dis tins, make una do wetin una fit do, so dat una go get peace and una go dey without stain or fault wen una go enter en kingdom.


Wi know and bilive sey, God love us and en love dey inside us.


Evritin for dis eart go woship am, even doz wey dia name nor dey for God Lamb book wey get life.


Di beast wey yu si, dey before, but e nor dey again and e go soon raiz kom from di pit kon start to distroy. Den doz pipol for eart wey dia name nor dey for di Life Book, go fear di beast.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ