Dis leta na from Paul, wey bi Jesus Christ apostle, bikos na so God wont am. I dey rite to God pipol wey dey for Efesus, di ones wey dey follow Jesus Christ with faith.
God nor dey support pipol anyhow. E go remember how una help en pipol before-before and how una still dey help dem naw. Una bi God pipol and E nor go forget di love wey una show en shidren.