Make una nor dey sturbon like una papa, but make una obey God as una dey kom en house wey E don make holy forever. Make una serve am forever, so dat E nor go vex for una.
King Zedekaya attack King Nebukadnezzar wey don make am swear with God name sey e go dey loyal to am. King Zedekaya sturbon well-well and e nor gri turn from sin kom meet di Oga wey bi Israel God.
Una dey go di land where milk and honey full. But I nor go dey with una, bikos una bi sturbon pipol and if I travel with una, I fit go distroy una for road.”
kon sey, “My Oga God, if I really dey good for yor eye, make Yu go with us, bikos wi bi sturbon pipol; make Yu forgive us awa evil and sin kon take us as yor pipol.”
Di pipol wey I dey send yu go meet so, dem sturbon well-well and dem nor dey respet mi. So I dey send yu go tell dem wetin mi, God wey get pawa dey tok.
“Naw, make yu go tell Israel pipol dis message wey mi God wey get pawa get for dem: Wetin I won do nor bi bikos of una, but na bikos of my holy name; di name wey una don disgrace for evriwhere.
For dat time, I tell dem sey: “Di Oga wey bi una God don give una dis land as una own. Una sojas wey don ready for war go cross first, before Israel pipol go follow for back.
bikos I know as una sturbon rish. True-true, as I stay among una kon rish today, una still dey disobey God; so how una sturbones go kon bi wen I don die?