So Moses dey der with Oga God for forty days and forty nites; Moses nor chop bread or drink wota. E rite di kovenant word for di two stones and na dem bi di ten kommandment.
Wen I rish where una dey, I si sey una don really sin against di Oga una God and una don make juju for unasef; una don kwik-kwik turn komot from di way wey God kommand una!
Den I go stay for God present for anoda forty days and forty nite; I nor chop or drink anytin bikos of all di sins wey una don kommit wen una dey do wiked tins wey go make God vex well-well.