Den Moses tell Aaron, “Make yu take di kontaina with incense kon put fire inside am from di altar. Den kwik go di kommunity side go do sakrifice to make dem holy, bikos God go send one bad diziz kon meet dem, since E dey vex for dem.”
Moses pray for Levi tribe sey: “My God, Yu don give yor Tumin and Urim to doz wey dey fear and respet Yu. Doz wey Yu don test for Massah kon follow dem kworel for Meribah wotaside.