21 I take una sin; di juju wey una make kon melt and grind am till e bi like san-san. Den I pour am for wota wey dey flow kom from di mountin.
E remove en mama Maaka, as kween moda, bikos e dey serve Asherah juju. King Asa skata di juju kon burn am for Kidron Valley.
E distroy di altar, Asherah juju and di oda juju kon skata all di incense altars wey dey for Israel town, den e go back to Jerusalem.
E take di melu wey dem make, burn am inside fire; grind am to powder kon pour am inside wota and e force Israel pipol make dem drink am.
Una go distroy una juju wey dem make with silva and gold. Una go trowey dem like rag wey dem take klean groun kon sey, “Make una take dem komot here.”
Bikos I know sey di time go kom wen all of una go trowey di juju wey una use gold and silva take make.
Di more Israel pipol dey build altar to remove sin, di more dem dey get many place where dem go for dey sin well-well!
I go skata all di image kon burn all dia juju propaty, bikos dem buy dem with ashawo money kon use dem pay ashawo for anoda place.”
God vex well-well for Aaron and E won kon distroy am too. But I pray for Aaron and God kon sorry for am.