Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Deutronomi 9:2 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

2 Di pipol strong well-well and dem tall; dem bi Anak shidren-shidren. Una hear wen dem sey, “Na who go fit fight Anak pipol?”

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Deutronomi 9:2
16 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

If God arrest and put pesin for prison or karry am go kourt, na who won stop am?


Di juju-men nor fit stand for where Moses dey, bikos of di boil wey full dia body and Egypt pipol own.


Siria sojas go do wetin dem like and nobody go oppoz dem. E go stand for di promise land and en pawa go dey komplete.


I si di ram dey waka with en horn dey go west, nort and sout-side. No animal fit stop am or eskape from en pawa. E dey do wetin e like and dey bihave anyhow.


I distroy Amor pipol, bikos of my pipol; men wey tall like cedar tree and get pawa like strong tree. I distroy di fruit wey dey dia tree kon skata di rut for groun.


Na who fit stand wen God dey vex? Who fit survive en vexnashon wey bi like hot fire? En vexnashon dey burn like fire and mountins dey skata to pieces for en present.


Wen dem pass thru Negev, dem kon rish Hebron for Ahiman, Sheshai and Talmai, where Anak shidren-shidren dey stay. (Naw, dem don build Hebron seven years before dem build Zoan for Egypt.)


But na strong and big pipol dey stay der and di town get betta wall and dem dey guide am well-well. Wi still si Anak shidren-shidren for der.


and wi even si some giant for der (wey bi Anak shidren-shidren) and wi bi like ant for dia front.”


Na wetin go happen to us? Awa own brodas don make us dey fear, bikos dem sey, ‘Di pipol wey dey di land big well-well pass us; dia kountry dey big and dem fence am rish heaven. Wi still si Anak shidren-shidren for der too.’ ”


Dem strong; many well-well and dem tall like Anak pipol. But God distroy Refah pipol, bikos of Ammon pipol, so dat dem go fit stay for der.


E go put dia kings for una hand and una go remove dia names from dis eart. Nobody go fit fight una and una go distroy all of dem.


For dat time, Joshua attack and kill Anak pipol for di hill kountry, Hebron, Debir and Anab from all di hill kountry for Judah and Israel.


No Anak pesin remain among Israel pipol, but some dey for Gaza, Gat and Ashdod.


From der, Kaleb porshu Sheshai, Ahiman and Talmai wey bi Anak shidren


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ