Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Deutronomi 9:12 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

12 Den God sey, “Make yu get up! Just dey go at wons, bikos di pipol wey yu bring out from Egypt don dey sin. Dem kwik-kwik forget kon komot from di way wey I sey make dem dey live dia life! Dem don melt gold take make juju for demsef!”

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Deutronomi 9:12
16 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Dem turn back and dem nor kon get faith like dia papa and mama. Yu nor fit put hope on dem, bikos dem bi like bow wey don spoil.


So Moses tell di pipol, “Make una remember today wey una komot from Egypt where una for bi slave. Dis na di day wey di Oga una God take una komot with en great pawa. So make nobody chop bread wey get yist.


Wen di pipol si sey Moses nor dey kom down from di mountin, dem gada round Aaron kon tell am, “Make yu make one god for us wey go lead us, bikos wi nor know wetin don happen to Moses wey take us komot from Egypt!”


But God tell dem, “Israel and Judah pipol, wetin I won take una do? Bikos di love wey una get for mi dey kwik disappear like dew for morning; like dew wey dey vanish wen day dey break.


I sopraiz sey una kwik turn back from di Pesin wey koll una with en grace kon bigin follow oda tishing.


Bikos I know sey wen I don die, una go spoil unasef kon turn from dis way wey I kommand una. Wahala go kom meet una dat time, bikos una don do bad tins wey go make God vex.”


En pipol nor dey respet or fear am; dem nor dey bihave like en shidren and na dis bi dia sins. Dem wiked well-well and na lie-lie full dia generashon.


I dey tok like dis, so dat una nor go make juju kon kause wahala for unasef. Dis mean sey weda di juju bi like man or woman,


Remember sey una bi savant for Egypt and na di Oga una God take una komot der with en strong pawa. Na dis make God sey make una dey keep di Sabat Day.


Wen I rish where una dey, I si sey una don really sin against di Oga una God and una don make juju for unasef; una don kwik-kwik turn komot from di way wey God kommand una!


I pray to am, “My Oga God, make Yu nor distroy yor pipol wey bi yor betta propaty; pipol wey Yu save with yor own pawa kon take dem komot from Egypt with yor strent.


Dem bi yor pipol, yor betta propaty wey Yu take komot Egypt with yor great strent and pawa.”


But dis pipol nor undastand wetin dem dey tok and dis na wetin dem suppose to undastand without sey pesin tish dem. As animals nor dey tink before dem do tins, na so dis pipol dey bihave.


But dem nor still listin to di leaders, instead dem still dey serve and woship oda gods and dem nor do like dia grand-grand papa wey obey all God kommand.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ