Wen God give yu money, make yu tank God and enjoy am, but wen sofa kom, make yu know sey e still kom from God too, bikos nobody go fit tok how tumoro go bi.
“So man pikin, make yu pak yor load like sey yu dey komot di town. For aftanoon wen pipol still dey look, pritend like sey yu dey go Babilon. Komot from where yu dey kon go anoda place. May bi dia mind go tell dem wetin dey happen, even doh dem sturbon well-well.
So make una dey kareful, so dat una nor go break di kovenant wey una make with di Oga una God. Make una nor make any juju for unasef, bikos una God nor like am.
E let una hear en vois from heaven, so dat E go fit tell una wetin una go do. E make una si en great fire for eart here, so dat E go tok to una from der.
But make una look well! Make una dey kareful, so dat una nor go forget wetin una don take una eyes si. As long as una dey life, make una nor let dis tins komot from una mind! Make una make sure sey una tell una shidren and grand-shidren about dis tins.