Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Deutronomi 8:18 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

18 Una must remember di Oga una God, bikos na en dey give pipol di pawa to make money. If una obey am, di kovenant wey E make with una grand-grand papa, E go make am happen for una life.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Deutronomi 8:18
19 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Di present na two hundred woman goat, twenty man goat, two hundred iyu, twenty ram,


Na from Yu money and propaty from dey kom. Na yor strent and pawa Yu take dey rule evritin and Yu fit make anybody big and strong.


Den King Amazaya kon ask di profet, “Wetin yu wont make I do about di money wey I don pay take hire dem?” Di profet ansa, “God go give yu pass dat one.”


I go praiz God wey bi my rock, bikos na-im dey protet mi. Na-im train my hand for war kon give mi pawa to fight.


Dem nor win di land with dia swod and nor bi dia own strong hand make dem win, but na yor rite and strong hand with di shinin-shinin lite from yor face, help dem, bikos Yu love dem.


Wen God bless pesin, e dey get enough and nor-tin go make am regret.


So, make yu remember and honor di Pesin wey kreate yu naw wen yu still dey yong, bikos wen yu don old, yu go sey, “Life nor sweet again.”


I don still notis anoda tin for dis world sey; nor bi who run pass dey always win di race and nor bi di sojas wey strong pass, dey always win di war. Wise pipol dey hongry sometaims and just as pipol wey dey work hard nor dey always get money, na so too pipol wey know book nor dey always get betta life. All dis tins dey happen by shance, as long as yu dey di rite place for di rite time.


Dem tink sey di dream wey dem dey tok so, go make my pipol forget mi, just as dia grand-grand papa forget mi kon dey follow Baal?


But till naw, e nor ever gri sey na mi gi-am di korn, wine, olive oil and all di silva and gold wey e take dey woship Baal.


And naw, awa God, wi don bring di first fruit, plants and animal wey Yu give us for dis groun.” Make una put evritin for di Oga una God present, den bow woship am.


and house where betta tins full, tins wey una nor buy with una hand. For di land, una go fetch wota from well wey una nor dig and una go chop from vineyards and olive trees wey una nor plant,


If una listin to dis rules kon obey dem with all una heart, di Oga una God go really keep en kovenant wey E promise una grand-grand papa.


But na bikos God love una and dey keep di promise wey E make with una grand-grand papa. Na dis make God save una with en strong hand wen una dey serve as slave for King Fero hand for Egypt.


Make una make sure sey una dey obey all di kommandment wey I dey give una today. Den una go get long life kon many as una enter and stay for di land wey God promise sey E go give una grand-grand papa.


Israel pipol forget di Oga dia God; dem sin against am kon bigin serve Baal and Asherah juju.


God kon tell Gideon, “Di men wey yu get too many for mi to give una viktory ova Midian pipol. Dem go tink sey na dem win by demsef and bikos of dat, dem nor go kon tank mi.


E dey make some poor kon make odas rish. E dey honbol some kon make odas great.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ