Wen Babilon ofisas send pipol go find out about di sign wey happen for di land, God kon leave di king alone, so dat E go fit test am, make E for know wetin dey en mind.
Moses kry to God and God kon show am one stik. Wen e trow am inside di wota, di wota kon dey good to drink. So for der, God give dem laws kon try dia faith.
Wen Israel pipol si am, dem bigin ask each oda, “Wetin bi dis?” Bikos dem nor know wetin e bi. Den Moses tell dem, “Na di bread wey God send kom give una.
Den Oga God tell Moses, “I go give una bread from heaven and di pipol go dey gada di ones wey go rish dem chop evriday, so dat I go fit test and know if dem go follow my kommandment.
Doz profets wey dey si wetin go happen, make una nor listin to dem, bikos di Oga una God go dey test una, to know weda una love am with all una mind and heart.
Make una remember how di Oga una God guide una pass di wildaness for dis forty years, so dat E go fit honbol and test una to si if una go fit keep en kommand or not.
True-true! E make una dey honbol thru honga kon dey give una food wey una nor know (manna) make una chop. E do dis to tish una sey human being nor nid only food, but dem still dey alive bikos of wetin God tok.
Di pesin wey fit bear wen problem kom meet am, make e happy, bikos e don show sey en faith strong and e go get di crown wey get life, wey God don promise sey E go give pipol wey love am.
Dis kind sofa go show sey una faith na really one. Gold wey go spoil one day, dem still dey test am for fire, tok-less of una faith wey get value pass gold and e go bring praiz, glory and honor wen Jesus Christ go kom.