Una don forget God wey make una; di Pesin wey stresh heaven kon make di eart foundashon? Why una dey always fear pipol wey dey opress una; doz wey ready to distroy una? But naw, una nor go fear dem again.
Israel pipol, make una listin to di rules and law wey I won tish una naw. Make una obey dis law, so dat una go get betta life kon enter and stay di land wey awa grand-grand papa God promise sey E go give us.
But make una look well! Make una dey kareful, so dat una nor go forget wetin una don take una eyes si. As long as una dey life, make una nor let dis tins komot from una mind! Make una make sure sey una tell una shidren and grand-shidren about dis tins.
and house where betta tins full, tins wey una nor buy with una hand. For di land, una go fetch wota from well wey una nor dig and una go chop from vineyards and olive trees wey una nor plant,