Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Deutronomi 7:6 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

6 Bikos una dey holy and na di Oga una God bi una papa. From all di pipol wey dey di eart, di Oga una God don choose una to bi en own special pipol.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Deutronomi 7:6
33 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

I dey here with doz wey Yu choose as yor own; pipol wey nobody fit kount.


Jew men dey marry wimen wey bi strenjas, so dem don dirty God pipol wey dey holy and na di leaders and ofisas dey do dis tins pass.


Judah kon bi God temple and Israel kon bi en kingdom.


True-true, God don choose Jakob as en own and Israel pipol as en own pipol.


E sey, “Make una bring my pipol wey dey obey mi kom, doz wey make kovenant with mi with dia sakrifice.


I go take una as my pipol and I go bi una God. Den una go know sey na mi bi di Oga wey bi una God. Di One wey save una from Egypt pipol hand wen dem dey sofa una.


“But Israel na my savant! Di pipol wey I choose, wey bi my friend Abraham shidren-shidren;


pipol wey I koll and bring back from where di world for end kon sey, ‘Una bi my savant. I don choose una and I nor go rijet una.’


Even if na one pesin for evry ten pipol remain for di land, dem go distroy am, e go bi like oak tree or Asherah pole wey dem kut for groun or sometin wey dey holy wey dem distroy. Dis holy tin, na di special family wey God choose.”


Dem go koll una, “God holy pipol; di ones wey God save.” Dem go koll Jerusalem, “Di town wey God love and where E go stay forever.”


Dat time, Israel pipol dey holy to di Oga God; na dem bi di first fruit wey E plok and evribody wey won attack Israel, God dey ponish and distroy dem.” ’ ”


Tell dem wetin I dey tok. Wen I choose Israel, I promise Jakob shidren-shidren kon show mysef and tell dem wen dem dey Egypt sey: ‘Na mi bi di Oga wey bi dia God.’


So I tell una: una go stay di land and mi mysef go gi-am to una as una own; bikos milk and honey full am. Na mi bi di Oga una God and I don separate una from di odas.


Una must dey holy to mi, bikos mi wey bi God dey holy and I don separate una as my own.


“Out of all di families for di eart, na only una I know and kare for and bikos of dis, I go ponish una for all una sins.”


Oga God sey, “Dem go bi my pipol. For di day wey I go kom judge di world, na dem go bi my own. I go sorry for dem, just as papa dey sorry for en pikin wey serve am.


Na from Israel pipol God choose awa grand-grand papa dem and E kon make dem great for di time wey dem dey Egypt as strenja and E karry dem komot from Egypt with en own hand.


wey bi Israel pipol, go fit asept Christ. Na dem God choose as en own shidren, E make agriment with dem kon give dem en law. Na dem get di temple and wetin God promise.


Bikos una dey holy to di Oga una God, na-im make am choose una as en pipol wey E love pass among evry oda tin for dis world.


Make una nor chop anytin wey die on en own. Una fit gi-am to strenja wey dey stay una town or una fit sell am give strenjas. But make una nor chop am at-all, bikos una bi di Oga una God pipol. Make una nor kill or chop small goat wey still dey suck breast.


Today, God don sey una bi en pipol, en betta gift wey E value well-well, just as E promise, so una must obey en kommand.


If una obey am, E go karry una high pass evry oda pipol wey E kreate. Den una go get praiz, honor and evribody go dey tok good about una. Una go bi holy pipol to di Oga una God, just as E promise.


If una obey di Oga una God kommand kon do as E tok, E go make una en holy pipol, just as E promise sey e go bi.


Yes! God really love en pipol; all doz wey dey holy dey en hand. Dem waka as E dey waka kon do di tins wey E tish dem.


Make una remember sey di Oga wey bi una God, save and take una komot from Egypt, so dat una go bi en own pipol wey E go guide and na so una bi till today.


Bikos E love una grand-grand papa, E kon choose to bless dia shidren-shidren and na en own hand E take komot una from Egypt with all di wonders wey E do.


E die for us, so dat e go free and klean us from wikedness kon turn us to en own pipol wey like to do good tins.


But God don choose una to bi en priest and holy pipol, so dat una go prish di Good News, bikos E koll una from darkness kon enter en brite lite.


God nor sorry for di world wey dey before and E distroy am with wota, but save Noah wey prish make pipol do wetin good for God eye and di seven pipol wey dey with am.


If God do all dis tins, den E know how to save en pipol from trobol kon tie wiked pipol keep, so dat E go ponish dem wen E go judge di world.


God nor go leave en pipol, bikos E don make promise with una grand-grand papa. God happy to make una en own pipol.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ