Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Deutronomi 7:5 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

5 Dis na wetin una go do. Una must skata di pagans altar kon distroy all dia juju pilas. Make una kut dia Asherah pole for groun kon burn dia juju.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Deutronomi 7:5
16 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Dem bring di pila for di juju temple kom outside kon burn dem.


Wen Filistia pipol dey run, dem leave dia juju, so David orda en pipol make dem burn dem trowey.


E remove di juju altars kon skata dia stone, den e distroy Asherah juju pole.


Make una nor bow or serve dia gods kon do wetin dem dey do. But una must distroy dem finish kon skata dia juju to pieces.


E take di melu wey dem make, burn am inside fire; grind am to powder kon pour am inside wota and e force Israel pipol make dem drink am.


But una must distroy dia altars; skata dia images and kut dia Asherah juju poles trowey.


Dem nor go put dia hope for di altar wey dem make with dia hand or trust Asherah juju or di incense altar wey dem still make with dia hand.


God tell dem, “Make una nor make juju for unasef or make image, pila, stone kon dey woship am. Na mi bi di Oga una God.


una must drive all di pipol wey dey stay di land komot. Make una distroy all dia juju wey dem make with stone or iron and all di place where dem for dey woship di juju.


Apart from di altar wey una build for di Oga wey bi una God, make una nor ever use wood take build house for Asherah juju.


Make una nor ever build juju house kon woship dem, bikos di Oga una God nor like all dat kind tin.


Una go burn dia juju for fire and una must nor like dia gold or silva. Una must nor take dem, if not dem go bi trap for una, bikos dem nor dey good to di Oga una God.


I take una sin; di juju wey una make kon melt and grind am till e bi like san-san. Den I pour am for wota wey dey flow kom from di mountin.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ